Wednesday, October 09, 2013

A Warri Boy’s Letter To President Jonathan On The ASUU Strike

Below is a Warri boy's letter to President Jonathan
on the ASUU Strike. It is in pidgin English so get
ready for some laugh although the writer makes
some good points. Anyway, we'll let you be the
judge.
Oga Presido
First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last.
You be confirm ijaw pikin. As dat ur middle name
'Ebele' mean 'mercy' so make u pity ur children
settle their lecturers naa!
The matter neva tire u? Suppose say ur pikin wey u
born for belle follow us dey house, shey you for
never answer we lecturers them? Una say make we
bone kidnapping, militant things and all the bad bad
things dem go enter school, now na una com dey
f**k up. All the things wε̲γ we lecturers don teash us
for klass we don forget finish. Last last, na una go
still call us "half-baked", "half-roasted", abi na "half-
fried". Na una sabi!
Dem talk say person no fit run pass him shadow. We
dey hea dey watch you. Na ur time be dis use am
well, but we go jam for 2015. U don forget say
youths na we dey vote pass abi? Na we sef dey snatch
ballot box, dey do rally and som kain kukere things
dem wey una dey take win election. U go still nid our
help o. That time we sef go go strike. Shebi u sabi
waka witout shoe, u go carry ur leg do ur rally. No
thug for u. We no go snatch ballot make you for win.
If any maga try am we go fall hin hand.
So bro Jona, na ur opportunity be dis o make u code
this stubborn ASUU pipu make dem cary their
wahala enta class. We no say na rush them go begin
rush us but we no send. All join. Na who get leg dey
kuku pass exam no be who read. Na still who get leg
dey get beta work. Na Naija we dey. So make u do
something because our mate dem for private
university don graj finish. We don tire to dey beef
them. If u no shake bodi fast make u no forget say
university of militancy still dey admit dey neva even
release 2nd batch ooo!
Abeg try grit maale Patience well well (i thank baba
Godee say she and gran papa Soyinka don settle that
their quarrel), greet all those bad belle advisers wey u
get too, God pass them! Uncle Amaechi still dey
Niger-delta here o, hin don tire for ur mata. I dey grit
u for am too.
I go stop for here. E go be na.
Naija student for life!
Na ur waffi boy.
Source : informationNigeria

No comments:

Post a Comment

You're welcome to infoloaded.com, kindly drop a comment in the comment bo'x.. Dont just read let's know your opinion.

Rapist Caught In University Of Ilorin’s Girls’ Hostel (photos)

An alleged rapist was reportedly caught earlier today by Hostel security in Kam Abioye (private) hostel, University of Ilorin. According...